da trybe carry am go şarkı sözleri

Trybe Records 2Shotz Trybe Productions Eldee The Don When I dey primary five ehen I get one friend E no dey too dey class e no just send You see Emeka no know book but for class Everybody dey wonder how him take dey pass ole One day we get lecture wey Emeka dey dere Him just dey concentrate like say him mind dey there For where na gimmicks make we take no fear The boy just dey strategize some skills and ideas You don see two eyes dey offload your hand bag Wey person pass you con dey find your school bag Dey follow you dey argue on top am dey brag Ah ah na your own no get label for the tag Shut up my friend how you take know If I finish with you na your blood go dey flow Bros abeg now abeg no be so In fact when I take the bag I no know Thief my guy bag talk say him no know Thief ole carry am go E say na him first time abi no be so Thief ole carry am go When you hear bring tire your eye come clear Thief ole carry am go Carry gun carry knife only you no dey fear Thief ole carry am go See this man self see as you kack for office You dey form oga while your people them dey hiss Na pen you dey take do magical tricks You no dey touch money but money go dey miss Your five account them don full for swiss You dey chop and you think say them no go notice Wetin you dey do bad and you know this You say I'm smart and you are a novice Na true you talk but na thief be your work When your hear bring tire make you no shock Your job na with tie and corporate knocks Agbada or kaftan aso and rocks Na this one we dey call thief with style Chop alone and close the file Everyday empty promises go dey pile It is not my fault my brother but mean while Embezzle money talk say him no know Thief ole carry am go You say na your first time abi no be so Thief ole carry am go When you hear bring tire your eye come clear Thief ole carry am go Carry pen carry pidgin only you no dey fear Thief ole carry am go Your song never comot but e don dey Alaba As you sing finish them go carry am waka E go con plenty like cloth for Yaba E don dey go platinum but my pocket is flatter Na my own sweat them dey use make dough See these MCs thief my flow Put my life savings con carry am go Bring tire fuel matches oh no Pirate my CD talk say him no know Thief ole carry am go You say na your first time abi no be so Thief ole carry am go When you hear bring tire, your eye come clear Thief ole carry am go Ten thousand copies only you no dey fear Thief ole carry am go Carry am go Thief ole Carry am go ole Carry am go Thief ole Carry am go ole Bring tire Carry am go Thief ole Carry am go Ten thousand copies only you no dey fear Thief ole Carry am go ole Ajibole Ole Ajibole Ole Onye oshi Ajibole Ole Onye oshi Ajibole Ole Onye oshi Ajibole Onye oshi Ole Onye oshi Ajibole Onye oshi Ole Onye oshi Ajibole Onye oshi Ole Onye oshi Ajibole Let's dance
Sanatçı: Da Trybe
Türü: Belirtilmemiş
Ajans/Yapımcı: Belirtilmemiş
Şarkı Süresi: 3:35
Toplam: kayıtlı şarkı sözü
Da Trybe hakkında bilgi girilmemiş.

Fotoğrafı