gad the screamer no gree for anybody şarkı sözleri

I don't even know about you but I know say me I no dey gree for anybody Especially people wey be say dem no like as I no dey wan gree for anybody Olopa no fit catch tif but e wan teach me how to talk, omo, which kain thing At your age you suppose know say your job description no be witch-hunting We are never too scared of the midnight We go dey their body like skin-tight Go for the jugular, nobody go dey miss with the boys we go burst their windpipes So if you know say e dey bite you for body say we no dey gree for anybody E better make you think am twice cuz las las, we no dey gree for anybody this year No gree for anybody, no gree for anybody, weda na olopa Gree for anybody? Make we gree for anybody? Omo, iro lon pa No gree for anybody, no gree for anybody, weda na olopa Gree for anybody? Make we gree for anybody? Omo, iro lon pa Omo e come be like say the only time wey things pure na back in those days Nowadays, our leaders na priority dem busy dey misplace Imagine person like this oga, as somebody father or mentor No time to dey argue like this or that, na dem go later torment us This no be time for punchlines Their opinion no be my concern Dem no gree say we no gree, if na you, you go gree for anybody Simple things wey you go do, you no fit do, people dey kpai for Plateau Terrorists dey wan clamp us but old men go dey act like dem be cartoons Make a mockery of our police All of dem slow pass tortoise If you get tattoo, for their minds then e mean say you sef done become cultist Me I never see people dull like this Carry yeye matter for their head like this But then again, make I just sound the alarm say I no dey gree for anybody this year, eh No gree for anybody, no gree for anybody, weda na olopa Gree for anybody? Make we gree for anybody? Omo, iro lon pa No gree for anybody, no gree for anybody, weda na olopa Gree for anybody? Make we gree for anybody? Omo, iro lon pa My Hausa brothers go say damburuba My Yoruba family go say kila gbe, kila ju Wetin we done trade wey all these ones dey happen Na why Igbo man go just say nna zukwanuike, make una try dey rest, make una dey rest No gree
Sanatçı: GAD THE SCREAMER
Türü: Belirtilmemiş
Ajans/Yapımcı: Belirtilmemiş
Şarkı Süresi: 2:23
Toplam: kayıtlı şarkı sözü
GAD THE SCREAMER hakkında bilgi girilmemiş.

Fotoğrafı