ify uche never give up şarkı sözleri

Never you fear the storm It shall be over someday Never give up Never give up your ways Dem no fit break me but dem only make me Na the wahala make me who I be today I be strong, refined, defined and lifted guy Wey him God na maker of Heaven and Earth Him don load me with blessings every every And ma ma me with potentials for excellence The storm no throway me but carry me reach destiny Hallelujah! No fear that storm jor. We move Never you fear the storm It shall be over someday Never give up Never give up your ways No matter what you're going through It shall be over someday Never give up Never give up your ways Tears full my eyes many times Fear of wetin fit happen flood my mind I look to Yahweh like say Him dey fall my hand I tell am make Him no near my side again You no dey help people na so I scream Na adopted we be na as you get favorite You dey promise well well and we no see answer Na like this you hate me make I ask, God na wetin I do you Oh oh oh oh oh oh Never give up, Never give up your ways (Repeat) Yahweh carry me enter Job chapter 38 Say make I sit down as Him go question me Sebi you don man enough dey open mouth like say knowledge full your head I go question you and you go answer me Where you been dey when I laid the foundation of the earth Na who mark the dimensions as you know na? How about the measuring lines, you sabi abi Those questions big pass me o As I see say God big pass my challenges. If you know the battles wey I dey Fight for you without your knowledge How about Grace wey you dey enjoy You dey my mind always my son I know the thought wey I get for you. The thought of good and not of evil To give you an expected end Yahweh big pass our problems jor He is greater than what we call Him He is Almighty, Miracle worker, Obstacle destroyer, Game changer, Jehovah overdo He is all-knowing, All-powerful, everywhere Him dey and at the same time Him don bless me He go bless you too The battle is won already Make you resurrect every potential in you. See you at the top Na there I dey o already Yahweh is ever our God forever. Never give up, Never give up Never give up, keep on going Never give up, Never give up Never give up your ways
Sanatçı: Ify Uche
Türü: Belirtilmemiş
Ajans/Yapımcı: Belirtilmemiş
Şarkı Süresi: 4:15
Toplam: kayıtlı şarkı sözü
Ify Uche hakkında bilgi girilmemiş.

Fotoğrafı