ik joez democrazy şarkı sözleri

Yeah it’s your boy Illtwist TBFA!! You know what time it is!! Yeah, Yeah, Yeah, Yeah, get it!!! Everyday I dey pray for naija oh yeah! Baba God make you show us the way oh yeah ohoo! Everyday I dey pray make e better oh yeah! I dey pray make e better for naija oh yeah yeah yeah!! Ofeshe lo, ayakata, oh na na this is Democrazy!! Ofeshe lo, ayakata, oh yeah yeah this is Democrazy!! Ofeshe lo, ayakata, Ofeshe! This is Democrazy!! Ofeshe lo, ayakata, this is Democrazy!! Rest In Peace baba Fela to say you dey alive you for yarn wella The way this country dey go, me sef I no know Them call us giants of Africa but we no dey grow Biafra, boko haram, nah big problem! Herdsmen, militants nah who wan solve them Security no dey innocent masses dey kpai! No food no joy see the poor dey cry Forget punchlines I dey cap the koko. Mhen no job every street girl wan turn okpo Men dey shoot anyhow just dey form Rambo Work no! Handwork no! Nah to dey kill dey go Government dey F-up I swear them dey fall my hands Money come I don run fly my family go jand PDP, APC I swear all na joke Why militants go dey smile and civil workers dey broke, why!!! Everyday I dey pray for naija oh yeah! Baba God make you show us the way oh yeah ohoo! Everyday I dey pray make e better oh yeah! I dey pray make e better for naija oh yeah yeah…..yeah!! Ofeshe lo, ayakata, oh na na this is Democrazy!! Ofeshe lo, ayakata, oh yeah yeah this is Democrazy!! Ofeshe lo, ayakata, Ofeshe lo! This is Democrazy!! Ofeshe lo, ayakata, this is Democrazy!! Election time go come we go turn monkey Go sell our own voting rights for small money This is a serious matter bros it’s not funny All these politicians… they’re too cunning So so gist for newspapers nah so so trash I for say make them sell naija give us cash Small boy like me abeg who I be cos if them share the money sef e no go still reach me Wetin man go do sef nah to pray to God And anyday we see chop make we thank the lord Eberi papa sing am “make them dey pity us” oga president Abi una wan kill us?? Nepa wahala light we no dey see, but every month end then go dey serve us bill Bros abi na sunlight wey we dey pay for? Wayo no good abeg make una reason the poor chai!! Everyday I dey pray for naija oh yeah! Baba God make you show us the way oh yeah ohoo! Everyday I dey pray make e better oh yeah! I dey pray make e better for naija oh yeah yeah yeah!! Ofeshe lo, ayakata, ofe…. Ofeshe lo, ayakata, Ofeshe Ofeshe lo, ayakata, Ofeshe lor Ofeshe lo, ayakata, Ofeshe lor This is Democrazy oh!!
Sanatçı: Ik Joez
Türü: Belirtilmemiş
Ajans/Yapımcı: Belirtilmemiş
Şarkı Süresi:
Toplam: kayıtlı şarkı sözü
Ik Joez hakkında bilgi girilmemiş.

Fotoğrafı