k. blaq real talk şarkı sözleri

Omo For the place wey dem born me, water no dey flow NEPA light na for kings, meehhnn No be beans mehhnn If you manage, you go get light But em no go full, you go still pay for the bills, meehhnn.. (Bills Meehhnn) Poverty go take you to your kneels meehhnn No be only motor wey dey kills meehhnn Get many people wey no get light, sweat for their heels meehhnn You go know say them no get chills, meehhnn But we get hope If we fall small, we go stand up.. (Common.. Stand Up From There) Ain't no giving up oo.. Only popo fit to make us hand up And even with a man down, we go still dey man up.. (Man Down.. Man Up) (Hhmm) And you can't beef.. (Hhmmm) Cut una like suya.. No delay Nobody go fit relate.. (Wo) Una never dey mean to fight back, because all of una just dey play.. (Play) Leave peace talk.. I dey gee'd up Because many get hands but them no fit work Get many things wey me eyes don lock up for this world wey me self I no fit talk For this life rough If you get money to chop today, make you no rejoice oo Just because oo.. (Aagghh) You fit chop today, make tomorrow chop you First Off.. (Real Talk) My people dey here wey dey hunger Them no get strength to dey talk.. They don quiet.. (Quiet) The money wey belong to the masses e don follow politician go house.. E dey praivet.. (Private) My people dey suffer.. And food no dey Na who balance dey chop diet Money no dey, you wan try flex Hope dey.. Why Stress Balanced diet na for you wey never die yet.. (Hhmmm) Your leaders wey be monster Country e be like weapon wey them fashion against man.. Na to sell am, use the money prosper If life na bitch.. Them be pornstar.. (Oohh Wooww) And if you wanna talk about the many many story wey dey happen for the location we gather we dey see wey we mah no fit talk Omo.. Brain fit burst Leave peace talk.. War for the whole street boys Cause Leave peace talk.. I dey gee'd up Because many get hands but them no fit work Get many things wey me eyes don lock up for this world wey me self I no fit talk For this life rough If you get money to chop today, make you no rejoice oo Just because oo.. (Aagghh) You fit chop today, make tomorrow chop you (I No Send Them Taallkk) Bring your Ps them.. (Real Taallkk) Make we fix them.. (Real Taallkk) You see your children.. (Real Taallkk) We go teach them.. (Real Taallkk) Your wages and pension.. (Real Taallkk) We go increase them.. (Hmmm) All you ghatz do na to vote us back into the system
Sanatçı: K. Blaq
Türü: Belirtilmemiş
Ajans/Yapımcı: Belirtilmemiş
Şarkı Süresi: 2:45
Toplam: kayıtlı şarkı sözü
K. Blaq hakkında bilgi girilmemiş.

Fotoğrafı