kdiv coco emi lo khan (we dey para) şarkı sözleri
Oh wohhh
It's kdiv again oh!
Inna me country o joy
No light to much noise from me generator
Even fuel don scarce and we get crude oil
Dollar Dey rise up every 2seconds
Omo
The situation no be funny one
For Naija na cruise no matter the condition
The government no gree for anybody
Them make sure the hungry reach everybody
And we Dey para
Ee Dey hala
We suffer we Dey hunger
Emilokan
E dey choke us
No go land us in the gutter
Everyday different story
This no fit be the country wey you promise
And e Dey do like we no fit do nothing
Government wayward them no hear nothing
E no be chais for here
And price no dey go down for here
Even law of gravity no apply for here