m prince story şarkı sözleri

Wo good day sexy ladies and my rugged gentle men I bring you bitter story wey too sweet pass e BBN E get one of my guy wey he money long like CBN He use am thief my babe come make my bae go do BBL But wetin shock me na when me and my guy just take dey puff am We no funds na only Igbo money we get to offer So when we high we dey enjoy but real life we dey suffer Time come no money for food then we knew it was now tougher One bad day my guy get up say he wan run dey go HK Then for area we get one senior bros we dey call JK J for juju evian money sometimes self he's not okay I wan advise am but advise without money no okay Before then I get one babe wey fine and she sef too package Anybody wey curse me na so this my girl dey savage She know my skin no too full but na fine face she dey manage She dey encourage me but me dey look myself like garbage My guy don dey two months for HK him self don dey pack am My girl hear story na then she like tall guys slim and darker My head dey burst cause this girl say I be like Peter Parker She say yes no more hero now she sef wan to dey pack am Two weeks I no well I dey cry I dey take ampiclox Story worse I hear my guy and girl don dey get intercourse The thing off me and be like I don dey get internal pox I dey suffer my guy dey buy my babe gift like Santa Claus Hello superstar na your guy I call to say hello I dey vacation with your girl for Lag Eko hotel oh So if I come I fit buy you one or two strong martelo I reason God abi na my kidney na I go sell oh E no too sweet but me I thank God say ona be two Them say the young shall grow but I wan grow the young from little Che ona dey hear the story so many things I have been through Low budget Mary don dey wear skimpy things you can see through Who get bottle mark for body no suppose fear tattoo I know I was a beast but now so gentle as a cattle I go make the money then come back loud for second battle Before I forget this na part one Mona wait for part two
Sanatçı: M Prince
Türü: Belirtilmemiş
Ajans/Yapımcı: Belirtilmemiş
Şarkı Süresi: 2:27
Toplam: kayıtlı şarkı sözü
M Prince hakkında bilgi girilmemiş.

Fotoğrafı